12
1 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017 Dis na Treatment Report for NTDs (de poor pipo dem disease wey dem neglect) for inside 2017 AFRICA

AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

  • Upload
    others

  • View
    0

  • Download
    0

Embed Size (px)

Citation preview

Page 1: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

1 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

Dis na Treatment Report for NTDs (de poor pipo dem disease wey dem neglect) for inside 2017

AFRICA

Page 2: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

2 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

NTDs na de kain disease dem wey pesin go fit prevent and fit treat abi cure. Di pipo wey dey sofa dis kain disease for dis world dem pass 1.5 billion – 40 percent of dem dey live for inside Africa. Dis disease dem dey disfigure pesin; some dey make pesin no dey use part of im bodi well, or dey disable; even dis disease dem dey kill plenti pipo. Ontop dat one sef di disease dem dey make pikin dem dey very sick dem no go fit go skool; plenti pipo wey dey young for bodi no dey fit do work, so tee, kontri dem wey dia economi de grow go com de troway plenti billion dollars for di sake of dis kain disease dem.

Any action wey go helep defeat NTDs no bi only di koret tin to do, e also show say if we see bad bad tins weh deh happen to pipo, we go fight am comot. And e dey compulsory make di world achieve di United Nations target, wey dem dey call Sustainable Development Goals, SDGs, for short, plus di Agenda 2063 wit oda tins wey fit comot di hevi disease load; wey dey make pesin no fit use im bodi well-well abi pafuka wey im time neva reach for inside Africa.

POOR PIPO DISEASE DEM WEY DEM NEGLECT, WEY OYIBO DEM DEY CALL NTDS

“For 2018 na Ghana bi di first kontri for inside Sahara Africa wey don eliminate di disease wey dey blind pesin wey oyibo dem dey call blinding trachoma. Dis kain disease dey cos plenti pain, plus e de make pesin no fit use some part of im bodi (to dey disable). We no go fit achieve SDGs if we no fit take care of poor pipo for our society wey dey sofa NTDs plenti. Abeg African leaders like me, make we join bodi fight dis disease dem wey dey affect poor pipo for our continent. We don show sey we fit do am.”

Na me Nana Akufo-AddoPresido of Ghana Republic tok so

Page 3: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017 | 3

AFRICA20

17

Pipo wey receive di treatment Pipo wey no receive di treatment

418 million 192 million2016: 357 million pipo 2016: 255 million pipo

Since 2015 6 African kontris

don fight comot from dem kontri at least one (some even

fight comot pass one) of dis NTDsPipo wey need NTDs treatment,

com receive am

Dis profile dey show di progress wey Africa don make for di treatment wey consain di five common NTDs wey dey affect poor pipo, according to di report wey de World Health Organisation, WHO bring out for 2017. Dem dey use dis infomate take kakulate how NTD take appear for inside di ALMA report card wey dey show propa action (accountability), especially as e consain de SDG 3.3 and dat ogbonge plan wey evribodi go take get health care, wey dem dey call Universal Health Coverage (UHC) report.

69%

61% 54% 65% 69% 70%ELEPHANTIASIS

BLINDING TRACHOMA

INTESTINAL WORMS BILHARZIA RIVER

BLINDNESS

Pipo wey receive medicine

Pipo wey receive medicine

Pipo wey receive medicine

Pipo wey receive medicine

Pipo wey receive medicine

Page 4: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

4 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

HOW PESIN GO TAK SABI DE NTDS DISEASE DEM

ELEPHANTIASIS (LYMPHATIC FILARIASIS): Na mosquito de kari dis disease wey dey attack di way blood dey waka for inside pesin bodi. Dis disease dey give pesin fever, afta, di pesin bodi go begin dey swell up from

di waist go reach di legs. Man own be say, dia private part area wey oyibo dem dey call scrotum go swell up join. Dis disease dey bring plenti pain, e dey disfigure pesin, plus e dey bring stigma, wey dey make oda pipo dey run away from pesin wey get di disease. Pipo wey dey sufa dis kain disease sef no de fit move dia bodi well-well.

BLINDING TRACHOMA: Na bacteria dey cos dis eye disease wey dey make pesin eyelashes or hair wey dey pesin eye to grow move inside, instead of to grow come out. Di eye go dey scratch pesin wit plenti pain

until di eye go com finally blind, if dem no treat am quick quick. Pesin fit get dis disease wen dem touch de hand, cloth abi oda tins wey pesin wey get de disease dey use. Small-small insect wey oyibo dem dey call flies wey don touch dos tins wey dey comot from inside de eye abi nose of pesin wey get di disease fit helep spread di disease.

INTESTINAL WORMS: Dis disease dey make worms plenti inside pesin belle, especially small pikin dem. Di worms wey be like small-small snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com

make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like normal pikin. Na pesin shit (bodi waste), na im dey spread di worms plus de ground (soil) and water wey dey near wia pipo dey go shit for open place. Pipo wey sabi medesin dey call dis disease soil-transmitted helminths abi helminths wey ground (soil) dey spread.

BILHARZIA: Dis disease get oda names, like snail fever, abi schistosomiasis. Dis na becos na snail wey dey live near water dey kari dis disease. Di parasite for dis disease dey entre pesin skin well well go inside

im bodi go make belle swell up. Pesin wey get dis disease no dey fit chop food well. Even sef di disease dey damage wetin woman dey take born pikin for inside her bodi, and e dey put woman dem for tu much risk or make am easy for women to fit get HIV (di virus wey dey destroy wetin pesin bodi dey take fight disease).

RIVER BLINDNESS: Dis na disease wey dey put worms (dos tintili tins wey be like small snake) for inside pesin bodi. Na insect wey dey black wey dem oyibo dey call blackflies, wey dey live near river and stream

wey dey move fast-fast dey spread de disease afta de flies dem bite pesin. De condition dey make pesin dey scratch-scratch im bodi, so tee di skin go com change, afta di pesin no fit see again. Pipo wey sabi medesin dey call dis disease onchocerciasis.

Page 5: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017 | 5

HOW PESIN GO TAK SABI DE NTDS DISEASE DEM

216m

82m

182m

81m

142m

357m

152m

279m

117m

203m

PIPO WEY NEED DI TREATMENT

PIPO WEY NEED DI TREATMENT

PIKIN DEM WEY NEED DI TREATMENT

PIKIN DEM WEY DON REACH TO GO SCHOOL WEY NEED

DI TREATMENT

PIPO WEY NEED DI TREATMENT

PIPO WEY RECEIVE DI TREATMENT

PIPO WEY RECEIVE DI TREATMENT

PIKIN DEM WEY DEY RECEIVE DI TREATMENT

PIKIN DEM WEY DON REACH TO GO SCHOOL WEY DEY RECEIVE DI TREATMENT

PIPO WEY RECEIVE DI TREATMENT

2016

2016

2016

2016

2016

2017

2017

2017

2017

2017

61% 56%

54% 48%

65% 51%

69% 56%

70% 67%

ELEP

HANT

IASI

SBL

INDI

NG

TRAC

HO

MA

INTE

STIN

AL

WO

RMS

BILH

ARZI

ARI

VER

BLIN

DNES

S

Page 6: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

6 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

KONTRI 2016 2017

Algeria E no dey applicable 86Angola 7 10

Benin 58 77

Botswana 2 2 =Burkina Faso 88 88 =Burundi 16 17

Cabo Verde 61 No report

Cameroon 58 83

Central African Republic 32 1

Chad 10 1

Comoros 0 79

Congo 16 30

Cote d'Ivoire 69 75

Democratic Republic of the Congo 44 54

Djibouti 0 No report

Egypt 10 10 =Equatorial Guinea 0 No report

Eritrea 31 64

eSwatini (Swaziland) 90 92

Ethiopia 51 73

Gabon 1 No report

Gambia 8 72

Ghana 70 37

Guinea 65 86

Guinea-Bissau 1 20

Kenya 43 40

Lesotho 0 80

Liberia 62 71

Libya E no dey applicable E no dey applicable

Madagascar 56 9

INDEX FOR PIPO WEY GET TREATMENT FOR EVRI KONTRI

Page 7: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017 | 7

KONTRI 2016 2017

Malawi 89 91

Mali 35 90

Mauritania 0 3

Mauritius E no dey applicable E no dey applicable

Morocco E no dey applicable E no dey applicable

Mozambique 65 12

Namibia 1 No report

Niger 0 64

Nigeria 48 60

Rwanda 3 78

Sao Tome and Principe 8 No report

Senegal 44 66

Seychelles E no dey applicable E no dey applicable

Sierra Leone 81 85

Somalia 0 40

South Africa 3 2

South Sudan 3 1

Sudan 19 12

Togo 77 84

Tunisia E no dey applicable E no dey applicable

Uganda 64 68

United Republic of Tanzania 47 88

Zambia 51 56

Zimbabwe 44 12

E no dey applicable No report

Dem no need mass treatment

No report submitted

Treatment no reach 25 percent

Treatment na 25 percent go reach

75 percent

Treatment don pass 75 percent

Dem no follow di plan

Treatment dey go according

to planTreatment dey

follow plan

INDEX FOR PIPO WEY GET TREATMENT FOR EVRI KONTRI

Page 8: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

8 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

AFRICA FIT DEY GIDIGBA FOR FRONT ONTOP DIS FIGHT TAKE DEFEAT NTDS

Make African Union get task force wey go dey in charge of NTDsDi goal for di ogbonge plan wey dem dey call Africa Health Strategy (AHS) weh begin from 2016 go reach 2030 na to make evri bodi for Africa get beta life as dem agree for ontop Agenda 2063: “Africa wey we want” na di same tin for di SDGs, Sustainable Development Goals dem. AHS, na dat ogbonge plan wey dey support plenti investment wey plenty kontri dem go use take care for pipo dem health plus reduce di hevi load of disease dem. To stop NTDs na important tin wey di AHS wan achieve.Di African Union task force go helep spread de tin weh pipo soposs sabi about NTD disease dem for inside Africa. Plus, dem go make sure say kontri dem go use propa propa di medesin wey medesin kompany dem promis wey kontri dem go dey take treat disease evri year, so dat di world go fit meet di targets for take eliminate NTD disease dem.

Di African Union task force for helep set di real small small target for Africa weh go helep follow di WHO dem goal for take eliminate at least one NTD for 30 kontri dem?Na 194 WHO member kontri dem don agree for di ogbonge five-year plan. Di plan don put di target for take eliminate at least one NTD for 30 kontri dem from2019 go reach 2023. African Union fit show dem powa for take support SDG 3.3 if dem fit set de real small small target for Africa as e konsain di goal for di whole world wey dem go put moni down plus chook propa eye for di mata to make sure say wetin we talk we do am.

Make African Union member kontri dem show say dem go bring out moni for inside dia health budget take support NTD progammeEven sef, for take do di treatment and prevent NTD dem disease no dey cost plenti plenty moni. In fact, pipo wey sabi medesin don kakulate say e no reach US$0.5 to take treat one pesin for dis comon poor pipo disease dem.Medesin company dem dey donate free of charge de medesin wey kontri dem dey take treat NTD disease dem. Dis ogbonge donation wey Guinness World record recognize for January 2017 fit reach US$17.8 billion by 2020. But di sad tin be say no be evri pesin wey need treatment de get am. Di kakulation be say for evri US$1 wey dem invest to take deliver the medesin, na US$26 of di medesin dem de donate join.

Di time for di African Union to take important action

2

3

1

Page 9: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017 | 9

E dey necessary to dey recognize and salut kontri dem wey don achieve di elimination goals Some konri dem don show say no be only tok tok, e dey possible to eliminate NTD disease dem• Ghana na di latest kontri for Africa wey don eliminate di eye disease, wey dem

dey call trachoma for dia public health mata, dis na afta Morocco do di same tin for 2016

• Togo and Egypt nko, dem don get WHO pass mark say dem don eliminate elephantiasis from dem public health mata. Dis make dem di only two kontri for di Africa continent wey don achieve dis goal.

• Kenya sef don receive WHO well-done say di kontri don eliminate Guinea worm disease. Di kontri follow de example of Cote d’Ivoire, Niger, Nigeria plus Ghana for dis achievement.

4

Page 10: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

10 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

Dis index dey show de average coverage wey dem reach for di five NTDs for di plenti treatment. Dem dey use wetin oyibo dem dey call geometric mean, wey go make sure say de high coverage abi treatment for one disease no fit hide di low coverage for oda disease dem. Dis method go helep kontri dem know di progress dem dey make for di treatment of NTDs. Dis na di same method wey dem dey use measure di progress wey evri kontri dey make for different elements including di one wey dey show how kontri dey develop, wey dem dey call Human Development Index.

Dem no dey kakulate geometric mean if de element na zero. Na di values wey dey below dem de use kakulate dem:

• Di kontri wey im treatment of de disease dey zero percent, dem de kakulate am as 0.1 percent

• Wey di kontri no report anytin for any NTD disease, di kakulation tu na 0.1 percent

• Wey kontri eliminate one disease, di kakulation na 100 percent

• Wey disease no dey for de kontri, dem no de put am for de kakulation

NA HOW DEM TAKE DEY KAKULATE DE INDEX

Page 11: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

11 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

Design by Positive2

Photography creditsCover: © Marcus Perkins/Uniting to Combat NTDsPage 4: © GSK/Marcus Perkins, © Graeme Robertson/Sightsavers 2017, © GSK/Marcus Perkins, © Ruth McDowall/Sightsavers 2017, © Marcus Perkins/Uniting to Combat NTDs

Page 12: AFRICA · 2020-01-06 · snakes dey finish di beta tins inside de food wey di pikin dey chop, com make di pikin be like sey im no dey chop at all, afta, di pikin no go fit grow like

12 | How di NTDs, poor pipo disease dem dey affect Africa 2017

UNITING TO COMBAT NTDS, DI JOIN BODI MAKE WE FIGHT NTDSNa di ogbonge private and public sector collabo wey dey fight poor pipo disease dem wey dem neglect, so dat life go beta for plenti pipo weh pass one billion.

ESPEN NA DI OGBONGE PROJECT WEY DEM WAN TAKE ELIMINATE NTDSOntop de step wey no bodi don try before take fight NTDs disease dem, de World Health Organisation for Africa, don create ESPEN for take mobilise de necessary resources wey dem go use reach de London Declaration target dem for inside Africa.

JIFUNZE ZAIDI KUHUSU NTD NA WASIFU WA NCHIFor more infomate for NTD kontri mata contact Uniting to Combat NTDs to give you more infomate:www.unitingtocombatntds.org/[email protected]

@combatNTDs

AfricaREGIONAL OFFICE FOR